Monday 21 April 2014

Nigerian Student don die for Bangladeshi Lake Oh!

One 26year old Nigerian student, Tahir Manni Adam, wen dey study for the Islamic University of Technology, Gazipur, for Bangladesh na im dem for see say him dead body dey inside the school lake.
 
According to the story from one local newspaper for Bangladeshi, Dhaka Tribune, Adam, wen be third year student of Computer Science be go to the lake to bath but unfortunately him come drowned. According to police story, dem recover him body from the lake around 10.45pm on Saturday, April 19th and dem declare say him don  die wen dem reach the Tongi Government Hospital. Dem later take Him body to Dhaka’s Samorita Hospital.
 
Registrar of the school, Ahsan Habib while him dey confirm the incident say dem don order people make them go find out wetin really happen for the lake, and say dem don file the case for police station.

0 comments:

Post a Comment